More dan 150 pipo injure as earthquakes shake buildings for Turkey Istanbul – BBC

Link to original article

Pipo for Istanbul dey react to the quake dem dey tok on  phone for street

Wia dis foto come from, Getty Images

  • Author, Orla Guerin
  • Role,
  • Reporting from Istanbul
  • 23 April 2025, 15:28 WAT

    New Informate 33 minutes wey don pass

Several earthquakes including one 6.2-magnitude tremor don strike near Istanbul, e shake buildings for Turkey largest city and e force some pipo to run from dia apartment blocks.

For now, no immediate reports of casualties or wider damage, but Istanbul officials say dem dey check buildings, den warn pipo to stay clear of potentially-damaged sites.

Di largest earthquake on Wednesday bin strike around 12:49 local time (09:49 GMT) at a depth of 6.92 km (4.3 miles), na wetin Turkey emergency services tok.

Di epicentre of di 6.2-magnitude tremor dey located along di coast of di Sea of Marmara, for Silivri area about 80 km (50 miles) west of Istanbul.

Map show di epicentres of three earthquakes for di Sea of Marmara off di coast of Turkey

Istanbul govnor office say at least 151 pipo injure afta dem jump from high places sake of panic wey di earthquake cause.

For one post on X, e add say no recorded fatalities, and no residential buildings collapse.

One abandoned building for Istanbul Fatih district bin collapse, e tok, but dem no record deaths or injuries.

Energy and gas supplies, drinking water and sewage infrastructure no dey affected, Im add put.

Turkish officials bin report two oda smaller earthquakes, also dem record aftershocks.

Istanbul residents report bigger earthquake, dem say na one of di strongest dem don feel in years.

Pipo bin report say lamps and oda furniture fall down for floor for dia homes.

Selva Demiralp, wey be economics professor for Koç University, tell BBC say she bin dey wit her family for one high-rise building wen di earthquake strike according to am, e bin dey “quite scary”.

“Somehow, in di midst of di earthquake, we bin feel a deep sense of comfort—becos di whole family bin dey togeda,” she tok.

“We dey safe, e look like say e no damage buildings,” she tok. But she add say pipo bin dey nervous about whether di quake “na a foreshock itself” and di “real one still dey come “.

Pictures show wetin di streets look like afta di earthquake hit.

Large crowd gada for street. Some pipo dey siddon for ground, while odas dey make phone calls.

Turkish President Recep Tayyip Erdogan, speak about di earthquake for one children festival for Ankara, di kontri capital.

Im say im dey follow di situation closely and say search efforts dey go on, im add say ministers bin tell am earlier say “so far no problems”.

Meanwhile, education minister Yusuf Tekin don announce say schools for Istanbul go dey close on Thursday and Friday.

Im add say dem no report any serious incidents for any school for di city, although im say school gardens go dey open to members of di public to use dia as safe spaces.

Residents comot for dia houses afta di earthquake happun

Wia dis foto come from, Getty Images

One resident hold her dog as she dey look her phone

Wia dis foto come from, Getty Images

Residents dey outside dia house

Wia dis foto come from, Getty Images

For 2023, two giant earthquakes bin destroy southern Turkey, e kill more dan 55,000 pipo.

Istanbul na Turkey most populous city and na home to 16 million pippo – a fifth of di kontri residents. Di city dey just 20km to di north of di North Anatolian Fault Line.

Additional reporting by Mallory Moench

Spread the love

Read Kimberly's latest article discussing daily headlines

Gog-Magog: The Culmination Of Two Wars Simultaneously

Ezekiel 38 describes an internal war that turns regional. Two different allied armies will converge on Israeli soil. One will be in Israel to help with internal turmoil. The other will invade during the turmoil.
Read More:

Spread the love
0 comments

WWTTWD? What Will The Two Witnesses Do?

Forget The Great Reset. Here is “The Great Setup”! The games the nations are playing on the global population never cease. One of the steps of The Great Reset includes war. This war between Israel and Hamas is one of those wars.
Read More:

Spread the love
0 comments

 

 

 


 

Turkey